You for no
Say I dey shine my eyez
Coz na so so wahalla wey dey shine for my head top
You for no
Say na I jos dey parade my gari den granot
So sey hunger no go kill me now
Coz if I die now, I just don die for oyibo land
You for no
Say na my papa den mama na won make I travel som
Make dem dey see me to as Bossu
So dem go fit carry dem fugu den celebrate my dollar
You for no
Na me to I for get swag
Make I fit dey speak like oyibo
Make smoke dey commot for my mouth abi
Ha! You for no
Make I don coat
Den take serfee den post post for my facebook
Make my neighbors nor say me to I dey
You for no
Na make me too I don grab oyibo girl-y
Make I don get chwingorm kiss-y
Make I don do the tin-y
Make she don get belly bigg-y
Make my pikins get oyibo skin-y
Make dem talk like dem dey sing-y
Hahahahahaha you for no
Say me to I do sorm
Say me too I dey
Bot
If I die
You for no say
Ibi my stupidity wey kill me
So you for no.
This poem has not been translated into any other language yet.
I would like to translate this poem