Passing Six No Be Passing Sense Poem by Chris Jibero

Passing Six No Be Passing Sense

Rating: 4.0


U see wetin I see?
Abeg, no think say I be Baba Zik
But my eyes fit see far well well
Wetin dey shele sef?
No be small thing at all, at all o o
Na the thing wey happen yesterday
Dey happen again today
And na the same matter go come dey
Do selense waka pass us tomorrow

Na so this world be sha
E no dey change pass say man
Dey waka per second, per second
Like say e kolo
Or like say e dey do popi yes, popi yes
Like small pickin dem
Dey go lie down for im final bus stop
Inside six feet yonder

Girigiri no be power
To carry daybreak no be marry
Big belle no be bellefull
Fibroid no be fruit of the womb
Pickin tall no be say e don mature
Say person old no be say e wise
Body fine, face fine
No be say heart follow dem fine
Life no be banga soup and starch
Body no be wood
No be say head with mad man hair
No fit catch fire
Kaikai no be water
And passing six no be passing sense

Wetin man dey pursue
Pass the things wey dey pursue am
But na so so complain full im mouth
Every time
Like old wife wey sheri koko
Thief im husband
Make we hear something jare
Who wan play God?
Ok, make una tell me
Who sef beta pass Jesus Christ
Wey bad belle people quench for cross?

(C) Chris Jibero.

COMMENTS OF THE POEM
READ THIS POEM IN OTHER LANGUAGES
Close
Error Success