Naija Style Poem by Emmanuel Odum

Naija Style

Rating: 5.0


We no send at all
wether the world dey bend
even we dey crawl
we must to reach the end

coruption na our sister
e full our back yard
jealousy na our brother
dem help us play the card

All of us dey hustle
and no body dey slack
we drink suffer from bottle
upon say we no lack

We run dey go away
some say e go beta
every koro wey you dey
our mother land tanda.

COMMENTS OF THE POEM
David Desantis 11 April 2008

i like the cool diff style english

0 0 Reply
Will P. Litter 11 April 2008

That was a bit different, nice though. Thanks for sharing

0 0 Reply
READ THIS POEM IN OTHER LANGUAGES
Close
Error Success