Which Kin Yawa Be Dis? (Poem In Nigerian Pidgin English) Poem by Chidi Anthony Opara, FIIM, CDOA

Which Kin Yawa Be Dis? (Poem In Nigerian Pidgin English)



Bomb blow,
Country people wound,
Country people die,
House dem damage,
Property sef spoil.

Country man
Wey dey advise Presido
For security matter
Come yan say
Na because of election
Wey dey come
Na im make bomb dey blow.

Presido
Come yan say
Na lie adviser talk,
Opposition come hala say
Make Presido sack adviser.

As dem dey talk talk,
Bomb still dey blow,
Country people still dey wound,
Country people still dey die,
House dem still dey damage,
Property still dey spoil,
Which kin yawa be dis?

COMMENTS OF THE POEM
Olufunke Ayeni 25 September 2015

lovely poem...they keep talking ppl keep dying

0 0 Reply
READ THIS POEM IN OTHER LANGUAGES
Close
Error Success