Diaris Godoooo! Poem by Rex-mayor Ubini

Diaris Godoooo!



Abeg waitin dey se le!
Why u let sadness
Cast ha shade for your face
Wey sun dey look for place
Bcos say u neva see chop
Abeg no fear
Na only u waka commmme
Abi you never hear
Diaris godoooo!

Nose no die
Nose no rorti
Nose no kpeme
Nose go breathe.

No let igbudu monki
See u make he loose hope
Forget the tori
Wey make u nor dey cope
Bcos say u neva get owho
Bcos say u neva buy four leg
Abi bcos say u neva build your obi
Abeg no fear
Na only u waka commmme
Abi you never hear
Diaris godoooo!

Nose no die
Nose no rorti
Nose no kpeme
Nose go breathe.

Tuesday, July 29, 2014
Topic(s) of this poem: hope
COMMENTS OF THE POEM
READ THIS POEM IN OTHER LANGUAGES
Close
Error Success